He posted the very hilarious joke on his Instagram page
Read below
If Na some Naija carpenters build that crucifix...#goodMonday for be #goodfriday They will sha have an excuse... "Shebi they have sentenced him? What's the hurry?"
"Abeg
abeg... If I hear? If una need cross since Na two days to crucifixion
Na hin una go come dey pressure me? Why una no book am the day wey una
sort Judas? Abeg ooo" "We are on strike.
The Jesus is a son of our member. We no go gree" "I told you to pay since you dey delay.
The
wood don dear, because of exchange rates" "You that is asking for
express, you get light? Abi Na teeth we go take sampaper am? Abi you no
see fuel queue?" "No be small thing ooooo! VIO seized the truck with the
nails.
They said there is no C-Caution." "Its first come first serve ooo! We still dey build Dasuki and Oliseh Metuh own.
The
other wood wey you dey see so Na for all them service thiefs, sorry,
Chiefs... By the way, where is the balance of all the other cross we
have done? Shebi una say until they sign budget... Una allowance did not
wait till dey signed budget ooo! In fact... The cross will be ready on
May Day...
No comments:
Post a Comment